Short Love SMS in Pidgin English

Best love SMS in pidgin English: Hey! Have you been thinking of the best way to share love with the love of your life? I understand, in a time like this, we need someone to think for us. To give us the best words that resonates with the moment. Your wife, husband, girlfriend etc have been there with you through thick and thin, it’s natural for you to look for a romantic ways to celebrate her , and it doesn’t necessarily have to be on birthdays alone. But also in ordinary time, when there’s no occasion, you can reassure her of your unending love. So, so you have the best love SMS in pidgin English you see!!!, we got you.Love messages for wife in Pidgin English

Short Love SMS in Pidgin English
Photo Credit: Pixabay

Let’s see, Happy new month in Pidgin English

1. My Iyawo, you sabi say I no go ever do anything without you , as come dis life, everything about change. I celebrate you.

2. Nothing wey I go fit do without thinking about you , my life don beta say I jam you. I been dey Waka, dey go East and West , e come like say nothing wan get head. Daalu.

3. Na you be the woman of my dream, e totori me say I wake up every morning with you beside me, I no even no wetin I go do without you. Make God bless you and the land you dey Waka untop, everything wey I go use dey support you for dis life so, may God bring am come our way.

4. Nwanyioma, you past no go better pass your future, as you fine like early morning rising sun, na so everything wey surround you go continue to dey shine, nothing go kill your joy, . Ahurum go n’anyi.

5. See as person wife come fine, she come dey get joy add am, Beke m, if to say you fit enter inside my heart, come see the kind celebration wey dey go on for that wey, you go understand better anytime I tell you say I love you.

6. One thing wey I don do for this life wey I no regret na to marry you.

7. The dey wey you gree marry me be the happiest day of my life, I hapi until I begin dey cry, come dey ask myself, how I carry get this kind fine woman join body as my wife. Even as e dey, I still never understand.

8. Plenty reasons dey wey I go take dey thank God, but the first one be dey thanks wey I go give Baba, say Him carry you come my way. Na you be my life greatest achievement. No Caps.

9. Woman wey God create on a Sunday, my sunshine, wifey wey dey give hubby joy.Funny Love Messages for wife in Pidgin.

10. I will pamper you pass small pikinAs you dey take care of everyoneNaso I wan dey take care of you.I go dey for you my Sugar.

11. Your love dey sweet meIf I fit come back to this worldNa you go be my wife.

12. I still dey imagine how I take marry you.I wan appreciate you for everything you dey do.

13. Na from my heart I take love you, nothing wey anybody fit do about it. Since that day we see, I no sleep again, abi dey thinking about you sotee you come gree to be my wife. You do well.

Naira Short Love SMS

So, how do you say love in pidgin English. 

Why writing love messages or short love SMS using pidgin language or say pidgin English? Well, there’s no definite language for love. Love speaks and understands all the languages in the universe. It also goes ahead to know signs and actions. Yes, you can love someone with these gestures, and the heart it goes to will understand. Somyarriy’s Blog, knows what they’re doing by writing on this topic using the specified language. Pidgin Language is a kind of fun. The use of some words makes it so. Imagine trying to say something like please, go and sit down, as Abeg go sitdon. It will sound funny and at the same time, depending on the usage, it won’t come as an insult. So we want you to have a happy and fun home, that’s why we’re writing the love SMS for pidgin English to your love one.

  1. My Yoriyori, the sugar wey dey my tea, I love you pass my mother. 
  2. I don Waka reach everywhere, no one be like you..you na my king, I love you.
  3. Wetin I for do if I come this world I no see you, maybe I for go back be that. See as I take love u.
  4.  I no wan wake up even if this whole thing come be dream, I wan dey dey enjoy am.
  5. For my life, I no no say I fit love pesin pass myself. See as I dey blush. I love you here and there.
  6. Man wey pass you no dey. You to fine like papiwater, everything about you set. You na better man.
  7. I sure say God take him time create you. No be like all us of. You too fine pass morning sun. Like this I love you.
  8. O bim, you na king of my heart. Na only peace and joy dey occur for life ever since I know you. No leave me alone .
  9. Love is beautiful when you come dey with your own person, stress no go dey, every day go be like Christmas. I dey enjoy our friendship.
  10. One journey wey I don start wey I no regret am, na they one between me and you. If we start afresh , I go still go with you. 
  11. Love in pidgin just for you, the thing go totori gi , me I know wetin you dey gbadu. 
  12. I love you toritolum. All over your body. I will be your love forever and ever.
  13. I dey send hugs and love come your side. My heart dey wia you dey.
  14. My life dey empty without you. Please do go, come back, I want you.
  15. Kilode!! Wetin dey sup, see as I love someone pikin , I for think say na juju but no, you deserve every love you’re getting from me.

Say you still dey read these ogbonge love messages reach here, mean say you sabi and the messages too dey totori you. Lol!, But that’s true, I mean who will read such sweet, funny Love Messages for wife in Pidgin and stop half?, Nobody.

Short Love SMS in pidgin English

You see, love in Pidgin English lines are quite interesting, if you sabi yarn am, no Lele. But if be say you no sabi, calm down and still follow us dey roll dey go.

Naija Love SMS
Photo Credit: Pixabay

16.My Star, I no blame king Solomon for Bible ontop 900 women wey dey em life, na because say him no meet you.

17. Just as parable of lost sheep dey , me I go leave trillions behind to go find you.

18. Na you be the best thing to happen in my life, I no regret am one bit.

19. You be the woman wey dey after my heart. Darling.

20. Even if the entire world dey, if I one back for this world I no jam you, I go return to where I came from.

21. You’re amazing bitiful one, no gree make anybody tell you otherwise.

22. You know say na every day, I dey pray for you. See as my heart dey beat duke duduke. You’re my sunshine you’re my life. Please stay.

23. My babe, let’s roll forever.

24. My painkiller, you na paracetamol wey dey cure my headache, once I see you, my happiness dey increase. 

25. You na everything I don dey pray for, I happy as I finally come met you and you come be mine. Make we dey Waka this forever journey as one.

26. Them say where person treasure dey, there his heart go dey, you’re my treasure and my heart is with you. Keep it safe.

27. I no fit leave without you, of what use will it be. Please be mine forever.

28. My joy no no bound since I find you. You’re everything a woman should be and more.

29. The most beautiful woman on earth. I love you more than life itself. 

30. Where my heart is.My bestieOmaricham, everything about you dey give me joy.If I marry you finish for this life, in the next life we will continue.

31. You na my prayer answered, aswear.No better gift to me pass you.My life come align Wella since I marry you.I love you plenty.

See also best birthday wishes in Pidgin English

So as man wey you be, sabi you have seen how to write correct love messages in pidgin language for wife ? No just dey answer Papa Bomboy for mouth, dey appreciate you woman every now and den. All these beta messages wey you don read so, dey put am to practice, I no write am say make you just read am and digest, mba! , Na make you for use am , dey show love to Mama Emeka abi wetin you dey call your Iyawo, call am those sweet names and make her dream come true. Every woman dey like man wey dey romantic oo, make you know.