Nigerian Pidgin English been a language derived from English and other local dialects is acceptable in most African countries especially the Western parts. One of the features of this ancient language is the ability of people from different walks and tongues to understand it. At times it sounds sweet, funny and inspiring , it has the best words to describe situations. And because of these features , today we are looking at a country in West Africa, so let’s see Nigerian pidgin proverbs and meanings, we hope to draw motivations and inspirations from these wise sayings. And to achieve these, we took out time to explain the proverbs and also give clues of their English meanings where necessary.

Ok, now wey we don explain things for up, you too no dey worry about pidgin English so, we bin say make we shalaye give those ones wey be say no too Sabi this ogbonge language. Now wey we don do that, na em be say we go go straight to the matter wey carry us come here, and wetin be the matter na Nigerian pidgin proverbs and their meanings. No think say na that kind motivational speakers talk you wan come read here, no, na as Naija proverbs in Pidgin dey be we wan Yan, and after reading, you go see say na comrade herself wey get PHD for Pidgin language write. No be chochocho. You get? Oya see.
No be by how far na by how well, so when you read finish rate us.
SHORT MOTIVATIONAL PROVERBS IN PIDGIN ENGLISH
We know wan write the proverbs in Pidgin wey go long, we wan write am make e short to read. Plenty people wey need motivation no dey get patience for plenty shalaye. Time no dey to dey check time, na em be say, go straight to the point you wan yarn, no dey parabulete, lol, I no say you dey enjoy all these plenty wey you dey read here. No go carry dictionary come dey check their meanings oo, you no go see them dia. My hands no dey oooo.
1. Table no dey turn , na pesin wey get brain dey change em chair.
Don’t stay one place waiting for opportunity to meet you, make a move.
2. Na small small Dem dey take chop food wey hot.
Patient is virtue, you don’t have to rush situation. Slow and steady wins the race is English proverb that is applicable here.
But you Sabi say if you chop food wey hot fast fast, e go burn your mouth. So dey chop and small small and watch as it gets finish. As we dey for life so, any challenge wey you face for life just dey do your best , as time dey go everything go normalize. You hear.
3. Na firewood person gather for dry season e dey take cook for rainy season .
This Pidgin Quotes tries to point at the importance of savings . It states that what one gathers during dry season is what the will feed on during raining season. It promotes hardwork at the right time so one will have something to feed on when the job is no more available or at retirement stage.
So as e take be, try Hussle well and dey save small small things as you dey Hussle. Chikina.
4. Say your indomie quick done, no mean say person wey dey cook beans dey lazy. This is to tell you that grace differs, that you’re progressing doesn’t mean the next person close who is not progressing is not doing anything. There is time for everyone.
5. Person wey carry umbrella go understand say na kaya wen rain don stop. Literally this implies that, once rain stops falling, someone holding umbrella will regard it as load. This also is applicable to our lives. Some people tends to regard those helping them as disturbance once they don’t need their service. These motivational quotes in Pidgin English will open your eyes to more.
If you like no go carry umbrella comot for rain because you no want make e be kaya for you .
6. Wetin carry us reach here na grace no be TP. This simply means that it takes grace for anyone to get to any length, it is not about TP. TP here means Transport Fare. So life journey is all about grace, we’re alive is also grace. See how far we have come.
7. Sun dey em dey and em still dey shine.
It means the sun is on its own and still shines. Yes, you don’t need crowd to get to the top, you don’t need the multitude, you can get there and shine all by yourself.
You know say anything wey you wan achieve put mind you go get am. Plenty no dey help matter. Go dey do wetin go make you become pesin , e no mean whether Dem support you or not. You hear. You fit dey you dey and shine, na wetin this funny motivational quotes in Pidgin talk.
8. Na only for assembly skool bell dey sound like noise, wen closing reach e go sound like music.
9. Make pepper soup from pepper wey life dey show you or you say, if life dey show you pepper make peppersoup.
Likewise you can make lemonade out from lemon. What ever situation you’re facing, try and learn what it is teaching you and make the best out from it. Don’t allow situations to weigh you down, that’s what the pidgin quote means.
10. To mad no hard, na the Waka wey de involve dey hard
To run mad is not hard, but what is hard in it is the trekking part. Do you agree with this particular pidgin quote?
11. Pikin wey em mama be charcoal seller, no dey ever get white clothes.
12. Mouth wey Dem carry collect loan different from the one wey them dey take pay am.
13. Fish wey never enter pot , no no say water get two sides
Fish can jump on water easily before it will that hot water exist also. Same water it lives in can equally kill it. Get the moral out from this beautiful pidgin quotes.
14. Person wey dey carry mouth drive no dey jam .
15. Make your head dey dey am, same clap for you na same to kill mosquito. You should be smart to detect praise singers and mockers.
16. If you like call am Solomon, pikin wey go wise go wise.
This is saying, that you name your child Solomon is not a guarantee that he will be wise.
17. Wia person hand reach e dey hang clothes. You don’t have to do more than your self. Same as saying cut your coat according to your clothes.
18. Nobody short, na person wey stand near you e depend on.
19. Las las, na two people dey dey for market, a man and a woman.
20. Say you sleep with me for the same bed no mean say we go come dream the same dream.
Read also Nigerian pidgin English Love messages
MOTIVATIONAL PROVERBS IN PIDGIN IN NIGERIA
You have the best proverbs in Pidgin and meanings here.
21. Better soup na money kill am. The good things of life involves money.
22. Person wey borrow clothes no dey dance for party.
When you add a party with borrowed clothes, you will be careful with it. You don’t dance with it literally.
23. Leave matter for Mathias and sabi for sabinus. Don’t put mouth in things that doesn’t concern you
24. No matter how you take vex, your hot anger no go boil beans.
25. Na woman wey never jam dey hold breath run. It’s saying ladies who have not fallen into trouble, normally run by holding breast.
Do I interpret this proverb?
Ok it’s saying someone who is in trouble will definitely forget everything to save life.
26. Cassava today can be garri tomorrow. Yes nah, it’s like saying he who is poor today can be rich tomorrow.
27. Nearly no fit kill bird. Nearly cannot kill a bird.
28. Today’s newspaper na tomorrow suya paper. A Nigerian pidgin proverbs reminding us that nothing lasts for ever.
29. Na from clap, you move legs and dance don start be that . This proverb is aimed at inspiring you to start from where you are, start small and you will make it big.
Similarly, that is to say, little drops of water makes a mighty ocean.
30. No forget say, chicken wey run away from Aba go Abakiliki go still end up for pit of stew or soup. Literally, what must be must be. Location won’t affect it.
31. Take afternoon time find black goat, on how night come, e go mix with darkness. Make hay while the sun shine is the English proverb of the above statement
32. Na who pass sabi book. Simply put, the end justifies the means.
33. Wetin an old man Sidon dey look, if small pikin start for tree him no go see am
It’s talking about the wisdom of the old. What an elder see while sitting if a small child climbs the highest tree , he will not see it.
34. Na wen pikin touch fire, him dey know say the colour no dey attractive.
35. Until pikin touch fire before e go know say e hot. Experience is the best teacher.
36. Dirt water too can quench fire
37. I get am before no be property.
Stop counting your worth with things that you once had, if you don’t have them currently the shouldn’t count.
Na the one wey we also dey say, if e didn’t dey , e didn’t dey. We move.
38. Na eyes, Dem dey take Sabi corn wey go sweet.
39. Monkey smart monkey smart,na because trees are closer.
Short proverbs in Pidgin English
Proverbs is mostly used by the old people. It takes a wise person to interpret it. And that’s why we have Nigerian pidgin proverbs and meanings here.
40 Do you know me, do you know me, na so traffic dey take start for road.
41. Na over ambition dey make lazy feel say him fit become crocodile.
42. Person wey present him head to use break coconut, no go follow chop.
43. Respect person wey don collect, but fear who e never reach.
44. Person wey naked, no dey put hands for pockets.
45. Cow wey hurry hurry enter Abroad, dey come back as corn beef.
46. Na strong head make February no complete.
47. To mad no hard, the Koko na the trek wey dey inside.
48. Na stubborn fly, wey no get adviser dey follow corpse enter grave.
49. Hustle oo, make them no use your teeth do opener.
50. Pikin wey use agbada clothes start shakara go talk wetin him go wear at old age.
I no say you dey enjoy all these short proverbs in Pidgin English, na em make you dey read reach here
O ya, laugh small and shame the devil, that’s how we roll, you know?
Read also Happy anniversary messages in Pidgin
51. Till today, nobody fit explain how water take enter coconut.
52. Person wey use elephant set trap, wetin him wan catch.
53. Akara and moimoi get the same parent, na wetin them pass through be the difference.
53. Difference between buns and doughnuts na packaging.
54. Come see me off, see me off, na like this them begin sale pesin in the past.
55. Say native Doctor travel go Londo no mean say the gods go sabi speak English.
56. He who get big teeth should dey read for big lips.
57. Who no go, no know. This means experience is the best teacher.
58. No talk say you no dey eat rat, you come dey use teeth dey share am for children
59. Rice the full put because of co- operation. This is to say, you will achieve alot working as team.
60. Man wey dey Waka around woman and no wan talk him mind go fetch water las las for her wedding.
How do you like our short Nigerian Pidgin proverbs and meanings so far? At least with what we have done above, you can learn Pidgin even if you don’t understand it, using their meanings as we explained will be of great help. Hope the inspired you. Go ahead , write to us about what you would want us to tell you in pidgin English. Keep visiting Somyarriy’s Blog for more ogbonge topics, trust us.