Love poems in Pidgin English: Love is in the air, Osheey. I can feel what you’re feeling, and that’s why you’re here, to get the best love poem in Pidgin English you want to share with someone so special to you. Well, that’s a good one. Love nourishes relationship and marriages, so getting the best line from us won’t be a bad idea.

Love dey sweet, when money dey, love dey scatter brain. But then you fit get money and you no get love, how you think say the whole thing go be? E go dey yamayama baa?, you too no go like am, so na m make we take our time like dis come arrange some ogbonge lines wey oyibo people dey call love poem in Pidgin English, the essence na make you dey use am dey whine the head of person wey you dey totori, say we say whine the person,no mean say you go open mouth waaaaaa, begin dey talk wetin you no go fit do, Abeg no do like that. No go promise woman range Rover wen you no get bicycle. We no wan separate fight like this.
Plenty talk no suppose dey for love matter, so make we yarn the talk reach like this, from your heart abi from your head, lol, anyone. O ya, check things wey you go tell your babe, so she go fit fall yakata for you.
1. Asampete Nwa di nma. See as person girlfriend come set. Sun wey dey shine for morning no reach you. If I no fall for you wetin I get.
2. The one wey hold my mumu button. Press me anyhow wey you like I go answer. Call me anytime wey you like I go still answer you. I fit climb anything for you. I go cross water for you sake. You know why? Na because I love you.
3. Iyawo mi. Oni temi. How I for take explain things give my children if I no meet you. You na wetin every man dey pray for and plus join. My life come dey sweet anyhow, just because I love you.
4. The love wey you get for me plenty. How you dey take tolerate me still dey baffle me. I don f**k up plenty times, My man, you no throway me. Aswear. nothing go make me to hate you.
Read marriage engagement messages in Pidgin English
Naija Pidgin Love Poems
5. I go dey for work dey smile. Office pipo go dey think werey wan do me. But them no go no say na bcos of you. I just dey think plenty things we don do together. My head come dey beat like person wey dog poshu for wia you dey.
6. For dream na only you I dey see. Everytime I see you there, I no go like wake up. Like say make two of us dey dey for our own world. That kind life for sweet if to say na wetin we go fit do.
7. If sun come come out in the morning,nko. E go dey do me say, my Sweetheart,don wake wherever she go dey, i go come smile, while I go just stand like signboard dey look the sun.
I go come dey see your face, My day go come dey brighten .
8. How you love dey do me. I no fit explain. I bin don consult plenty dictionary. Say make I check wetin dey sup to me. Each one I open , them say na you. I check Google for the symptoms I dey get. Na your name I still see everywhere. You’re my world.
9. You’re my sunshine. Na beg I dey beg. Don’t go away.
10. Life fit hard. But with someone like you. Even the rock go come be like say na foam. Wetin I wan yarn again.
11. My life no fit complete without you. If I come dey look future. See wia you position inside am. Chai, the thing dey give me joy. I happy say I see you inside am.
PIDGIN LOVE POEMS FOR YOUR LOVE

Have you been searching for pidgin love poem for your love. Worry no more, we have the best lyrics. We took out time to write the pidgin poems that will melts hearts and souls. That’s the essence, to keep the fire burning in your hearts through words.
12. Your love dey sweet me like sugar. E dey make my life tingaligarin. My tummy dey do like butterfly.
13. Oh Baby! You look like Cinderella. Dey play, see the beautiful flowers on your head. Dey turn, you can feel it, but na me dey see am. Just dey play, but I no dey whine you.
14. I don see plenty people for this life, but I never see the one wey be like you. Not even the one wey wan resemble you. You na special package, God give me. And I no go take you play.
15. Life no suppose hard. So I go fit take care of you. You deserve everything good.
Na why I dey double my hustle make I for take you go America. Buy you designer. Carry you enter Ferrari, abi Bugatti. Which other thing you go like make I do for you. ?
16. Sugar no sweet reach how you love dey sweet me. The thing dey do me tiriri. I never see this kind love before. But I happy say you’re mine forever.
17. You’re one of the greatest gifts of God to me. I cherish and adore you. Whatever it takes for you to live large. I will provide for you. You don’t need stress’s, allow me to go all out for you. You deserve nothing but the best in everything, my sweet soul.
Love poem in Pidgin English
18. Just like the morning Rose. You’re so bright, with beautiful mind. I draw inspiration from your glowing face and cheerful heart. Nothing will separate us , I promise.
19. Love for no dey possible. If to say God no create you. You know why? Na becos say, na you be the love yourself.
20. No be by mistake I take love. I go love you today. Love you reach tomorrow. And dey there for you forever my personal person. Amen
21. Na you be the best and main person in my life. The major component of my system. The air wey I dey breath, the sugar in my tea. My all in one,
22. My Flamingo, na you dey take my heart away. If I go fit come this life again, I no see you, I go go back. Wetin be the need to dey this world wen you no dey.
Read also anniversary wishes in Pidgin
23. Your Mama born you well, You fine pass Mami water, If na wrapper you be, you na holladis. If it come be land, you dey for site. I go travel the world with you.
24. Me and you be like 1+1. Nobody go talk wetin fit make me leave you. I fit die for your matter join. I go go anywhere for you sake. Make nothing bad happen to you. Amen
See good night message for husband
So, when next you want to express love and affection to someone dear to you, do it in a romantic way, and one of such is to use love poem in Pidgin English to rekindle the love. Love is a beautiful thing. Love dey sweet riririri, on how you follow who know road like our site.